Good day my lovely people today edition wey I carry come na pidgin sport...

Na the biggest match of the week for England I wan yarn you, the match na the one wey go sele for Wembley on Saturday at exactly 12:30pm.. As we don know sey the Liverpool team at this moment don win their all their games wey dey don play for the league this season wey they make people yarn sey they be tittle contender but na their last two matches wey dey hustke before they win con dey confuse people if they go fit carry the league cup or not..

but the report report wey we dey hear from Tottenham boss be say make Liverpool they ready o because as den dey, dey no go free Liverpool at all, but the problem be sey the spurs team go be without their first team keeper hugo Loris and their one of their midfield commando dele Ali due to injuries, and this Tottenham team en they dey on fire for their first 3 matches wey they play especially the one wey they scatter Manchester united for their home, the thing shock everybody including jose mourinho, but Tottenham no con fit do ham again against Watford oo they wan try ham but watford no gree for them na xo Watford tell them sey we no be Manchester united o, we no fear you at all naxo Watford wipe them 2-1.

But for Liverpool en, na all their first team players dey ready oo including their witch keeper wey they buy for big money and as the keeper dey en na only one goal him don concede for their four matches wey they don play meaning sey he don get 3 clean shit already.. And for Liverpool forward they hot pass anything and then they burn any team wey come their way, they no dey look face at all, if we remember last season wey den reach champions league final and their Egyptian witch Mohammed sallah wey win the golden boot for England and they con nominate ham again for FIFA best player and he con win England PFA player again..

Before the match go happen  on Saturday midday you fit drop your prediction for the match ..

Thanks